Dike Favour Charity

Public speaking no hard at all, na we dey over hype am. Before now, I dey always won talk to people. I just like behave as if say I be invited guest. I Sabi ask question for Africa especially that time wey I still dey secondary School. Sometimes I go know the answer but I go still ask and I go even want answer my own question again.

I no know say na my talent I dey showcase small small. Even for church, I dey like come out to present anything anywhere. I no just know where that Mooral dey come from.

This matter serious, sote… e don bring me out for school nah. For my class I no dey try ask anyhow question and I dey give better answer. E come make anytime I come out to do something or talk, everybody dey shook ear for ground to hear.

ALSO READ  Council Chairman Organises Cultural Day, Unveils Okadigbo Statue, Gives Awards

Na so one guy call me for one program, say e won Interview me. Na I ask am say, how you take know say I fit talk wetin you want make I talk. E come talk say, as e just look me e don know say I fit deliver.

See make I tell you, no ever say you no get talent ooo. Check yaself Wella. When you don find ya talent, just dey showcase am dey go. No fear anybody o. MTN talk say ” No be who go let you go be the question, Na who wan try stop you”.

My coach talk say ” IMPOSSIBLE NA NONSENSE!!”

ALSO READ  Abba Kyari: 10 Facts about the former chief of staff

Una Weldone o.

# certifiedcreativewriter
# certifiedpublicspeaker
#favourite

What are your thoughts?

Discover more from Odogwu Blog

Subscribe now to keep reading and get access to the full archive.

Continue reading